Dey Poo Anyhow (Dysentery) π½
No chop peppery soup, fried food, food wey get oil, meat, beans, suya, zobo, plenty milk or drink wey dey like fanta and coke.
Mosquito Bite (Malaria) π¦
Malaria dey show like common fever, but e no be small sickness β treating am early fit save pesin life
Water-water Poo (Cholera & Diarrhea) π©π¦
No give pesin fried food, meat, beans, milk, zobo or coke during diarrhea β e go make am worse
Blood for Bodi Small (Anaemia) π€π©Έ
You fit chop egusi soup and tomato stew but if you get cholesterol no chop di one dem dey fry to cook. You fit boil am or use small oil
Yellowish Eye and Bodi (Jaundice) π‘
No dey ignore eye wey yellow β na sign say liver dey shout for help
Big Head, Small Bodi (Marasmus) π§π§ββοΈ
Pikin wey dey dry no mean say na witch or bad thing β e fit just mean say e no dey chop well
Gum Wey Dey Bleed (Scurvy) π¦·π©Έ
No just dey chop only garri or indomie every time. Dey chop leaf you fit use cook for food too
Small Bodi, Big Bele (Kwashiorkor) π§ββοΈπ€°
Dey give pikin food with beans, fish, egg, and green leaf β no just give plain rice, pap (Akamu) or garri
Neck Dey Big (Goitre)
We dey talk about Iodine wey dey for food already. God don already put am for food wen He make am. No be the iodine dem dey use clean wound abegβe fit harm pesin
No Dey See for Night (Night Blindness) π
Night blindness no mean say pesin no go see at all like say e midnight. Even when place just small dark like evening or room wey no bright, pesin fit dey struggle see
Black Fly Bite (River Blindness)π¦
You fit ask your village head or community leader when health workers go come
High Blood Pressure (High BP)π©Έβ¬οΈ
Sometimes dis sickness no go show any sign, but e fit dey spoil your body inside quietly. Na why e good make you dey do regular check-up, even if you feel okay. Check your blood pressure and sugar well so that dem fit catch anything early before e become wahala.
Oil Dey Blood (Cholesterol)π©Έ
No dey chop food wey get too much oil or food wey dem use oil cook or fry. Even red oil and groundnut oil, no dey take am too much
Sugar Sickness (Diabetes) ππ¬
Sometimes dis sickness no go show any sign, but e fit dey spoil your body inside quietly. Na why e good make you dey do regular check-up, even if you feel okay. Check your blood pressure and sugar well so that dem fit catch anything early before e become wahala.
Liver Sickness (Hepatitis)
No share toothbrush, razor, or needle with anybody
Wound Inside Bele (Ulcer)
No dey let pesin wey get ulcer chop pepper soup, suya, or anything wey get plenty pepper
Water Don Low for Body (Dehydration) π§
Dey drink clean water all through the day β even if you no dey feel like am